Translate

Friday 19 August 2016

Manchester Utd don wild

Oboi, see us see wahalla. Wettin person no go see for Premier League, Na so our opponent come Old Trafford wan spoil party for Baba Mourinho, but our boys showthem who them who sabi pass.Water come pass garri as Ibracadabra show them say age no be football, but football Na with sense as he show them say he sabi score sef for English League. Na so our latest golden bros #Pogback show why we buy am for amount wey somepeople dey beef..(e no go better for rivals wey be enemy of progress).We come do amebo see as our fellow paddy dem for twitter dey make social media hot, me sef I follow them see say then mind don cool down well well as we no dey in the era of Baba Philo( make Ina no vex say I call him name).Oya make Una see as fans dey dance Skelewu as we dey sit down on top table for week 2 as at the time we play our second game.

posted from Bloggeroid

No comments:

Post a Comment